DESMOND ELLIOT :LEKKI TOLLGATE SHOOTING FROM THE LAGOS LAW MAKER MAKE SOME NIGERIANS VEX

DESMOND ELLIOT :LEKKI TOLLGATE SHOOTING FROM THE LAGOS LAW MAKER MAKE SOME NIGERIANS VEX



4 years ago

~5.6 mins read

Advertisement

Desmond Elliot dey trend for social media on top di comment im make afta di shooting wey happun for Lekki toll gate, Lagos, Nigeria on Tuesday 20 September.

For di house, im tok say "make celebrities, social media influencers stop di hatred, una get constitutional power to change tins with your PVC and if you dey tired, enta goment."

E also say if Nigerians no dey careful with di way looting dey go on for di kontri, in five years we fit no get any kontri.

Wetin else Elliot tok?

Elliot praise di speaker of di house say e condemn di katakata wey happun for Lekki.

E also yan say, "I like to thank di speaker on how e take condemn di carnage wey happun for Lekki.

Advertisement

Wen I enta di comments I no fit believe am, children dey curse upandan, dem enta Oba Palace tiff im staff of office.

Advertisement

In di next five years we no go get any Nigeria if we no start now.

"Di youth no be only those wey dey do di peaceful process, those wey dey loot, wey don destroy lives, dem be youth too."

Howeva for anoda video, e clear di air say im bin no dey try to push any bill to control social media, say wetin e bin dey try tok na to tell social media influencers make dem no dey use dia platform to spread hate for di kontri.

Skip Instagram post, 1

End of Instagram post, 1

E say, "I dey beg everyone say dis one no be true. No state house of assembly get di jurisdiction to pass any kain bill like dis."

But e no stop social media to bash, di former actor, even as Davido call am out say "e don spoil all di beta memories e give us as pikin with im feems".

Skip Twitter post, 1