PromzyCee

Articles
1
Followers
1

profile/3918PicsArt_08-02-02.04.52.jpg
PromzyCee
Twist Of Fate
~3.5 mins read
"My sweet Potato, my heart beat. Chai nne, if you leave I go delete. Nah you dey make my head dey kpangolo. See person pikin as e fine, come become graduate too."

"Obinna, we need to talk"

"No be talk we dey talk so? Abi nah the oda room talk you mean? 
Na wetin you dey talk small small? Come nah make we enter, go celebrate together for paradise. Infact, I go do you many many thin...."

"Obinna I'm serious. We need to talk, Now!"

"OK bebe. You want make we fess talk? No lele, I dey loyal. My oyibo professor..."

"Obinna, enough of this. 
First, I want to thank you for everything you've done for me and my family. We will always and forever be indebted to you. Training me through school, to be a medical doctor. I really appreciate it. In fact, I don't know how to thank you for...." 

"Haba nah... You no suppose dey thank me nah. Everything wey I do, na for us I do am. 
As you don finish so, when we marry, you go dey brush me up small small..."

"Ehhm, I was coming to that. I really don't know how to say this, but I'm in love with someone else. I met him in my second year, and we've been dating since then. We love ourselves and he just proposed to me yesterday..."

"What are you saying bebe. Stop to dey joke this kind expensive joke nah... You know I roff you with all my heart, and I know you roff me t..."

"No Obinna, I'm sorry it has to end this way. I really admire you. But I can't get entangled with you. I mean, you're not my class. Try to understand me please."

"So you mean say after I don sponsor you for school finish, you come discover say I be illiterate abi? My angel,  abeg no do me this thing nah, I roff y..."

"Please stop eeet! I don't have any feelings for you again apart from that of gratitude. I believe my fiance can offset the bills. I mean the money you trained me with... 
I'll invite you to my wedding. Once again, Thank you."

"Bebe wait nah! Heeeei! Wait naa! Make we reason well!......."


*****Two weeks Later******

"Obaino! You wan kill yourself? Nah woman wan make you use beer finish your life? You dey fall my hand oo."

"Chemoo you no go understand. I roff dah geh. I really roff am. Kai! 
Me! 
Odogwu na Atlanta. Nah because say I no go school oo... Chai!"

"Obaikoko! 
No reason am. Just chill. Oyibo people talk say dem never beautiful the born ones..."

"Hahahaha. I beta pass you sef... No be wetin you yarn so oo... 
Nah dem never born the beautiful ones."

"Anyone... All of them join. Oya drop this bottle, make we go hustle dey wait for the beautiful ones abeg..."


*****Two years Later*****

Knock Knock!!! 

"Yes who's there? I'm coming." 

"Good afternoon MA"

"Good afternoon. How may I help you?"

"MA, I saw the vacancy for the post of a nanny. I can do it well MA. Please MA. I really need this job MA. My life depends on it MA. My husband abandoned me and my one year baby, please help me to secure......"

"Young lady it's okay. Actually I'm not the one to select an appropriate nanny. My husband insisted he would be the one to choose. Just explain everything to him. I'm sure he will consider you. Let me call him."

"Sweetheart! Sweetheart!!!"

"Yes honey... I dey come oo"

"Please hurry, we have an applicant."

"OK see me here. Where the person dey"

"She's the lady over there...."


😲😲😲😲😲😲😲😲😲

"Young Lady, you sure say you fit do am?"

"Yes sir, I can... Please just help me sir, my husband aband....."

"It's OK. which day you wan resume?"

THE END! 

PS. The lady who abandoned Obinna, is living happily with her husband... 

#Fiction

Advertisement

Loading...

Link socials

Matches

Loading...