
#EndSarsNow

WIA DIS FOTO COME FROM,NIGERIAN POLICE FORCE
Nigerial central goment alias FG on Sunday ban FSARS patrol wit immediate effect.
From Wizkid wey blast Presido Buhari on top di End SARS to Teni di Entertainer wey dey remember how dem kill her papa, many Nigerian celebs join #EndSarsNow #SarsBrutality campaign on Sunday.
Tori be say viral videos wey expose police brutality across Nigeria over di weekend many many konti pipo angry sotey celebrities cari di mata for head,
Rudeboy PSquare dey ask say how long SARS go continue, post video to demand di end of di Special Anti-Robbery Squad SARS.

Wizkid, Temi, Naira marley dey para on top SARS mata
Di order wey come today in response to social media protests on SARS wey plenti celebs dey spear head.

Squad to fight armed robbery plus violent crimes.
Nigeria Police SARS patrol dey banned wit immediate effect, federal goment announce on Sunday.
E follow plenti complaints wey many young Nigerians hala enta social media wit #EndSarsNow #SarsBrutality dey top Nigeria latest news about attacks and harassments dem dey suffer in di hands of SARS.
Nigeria police bin create SARS wey mean Special Anti Robbery Squad to fight armed robbery plus violent crimes across di kontri.
End of Twitter post, 1
One tweet wey di office of Nigeria president post on Sunday tok say Nigeria Inspector General of Police, Mohammed Adamu, don ban di staff of di Federal Special Anti-Robbery Squad (FSARS) plus oda tactical squads of di force from doing routine patrol wit immediate effect.
IGP Adamu give dis order afta investigate wey di leaders of di police do find out say some of dia staff dey hide under authority wey goment give dem to dia work, to do all kains of illegal tins wey dey against di Standard Operation Procedures, Code of Conduct and Rule of Engagement wey di squads suppose follow.

Advertisement

Link socials
Matches