NIMC Registration Deadline: How To Know Nigeria NIN Sim Link Deadline Penalty For MTN, Airtel, Glo, Etisalat Lines

NIMC Registration Deadline: How To Know Nigeria NIN Sim Link Deadline Penalty For MTN, Airtel, Glo, Etisalat Lines



3 years ago

~12.8 mins read

Advertisement

NIMC registration deadline: How to know Nigeria NIN sim link deadline penalty for MTN, Airtel, Glo, Etisalat lines

19 January 2021
NIMC registration deadline: NIN link for MTN, Airtel, Glo, Etisalat sim cards

Di deadline for subscribers with di National Identification Number (NIN) to link am with dia mobile number na 9 February, 2021.

Nigerian Communications Commission (NCC) and di Minister of Communications and Digital Economy, Dr Isa Pantami bin give until December 30, 2021, for subscribers to update dia details or risk blocking of dia lines.

Advertisement

Dem later extend dis date to 19 January, 2020.

However di new date [NIMC deadline] now na 9 February, wey be anoda extra three weeks from today for those wey no get NIN..

Oga Pantami wey tok dis for im tweet dis say di process still continues.

Tori be say NIN-SIM linkage deadline of 19 January na for those wey already get NIN, that means those wey already dey registered with di NIMC.

February 9th, na for those wey no get NIN, that means those wey dey yet to register with di NIMC.

Most Nigerians don dey beg goment to extend di deadline but goment Neva tok anything about di extension.

If dem no shift Di deadline, e fit get effects on Di kontri economy.

Advertisement

According to figures from National Bureau of Statistics, telecom sector don contribute 31.8 trillion naira to Nigeria Gross Domestic Product (GDP).

NIN-SIM linkage deadline last-minute important informate na say those wey already get National Identification Number (NIN) and never link am to link to dia phone numbers, fit still do am now, before 11:59PM 19 January, 2021.

Di NIN-SIM linkage USSD Code na: MTN: *785#, Glo: *109#, Airtel: *121*1#, 9mobile: *200*8#, To retrieve your NIN: *346# for FREE.

  • After di deadline, all SIMs without NINs go dey blocked from di networks.
  • One Ministerial Task Force comprising di Minister and all di CEOs for di telecoms sector (among others) as members is to monitor compliance by all networks.
  • Those wey disobey dis directive go face hard punishment, including di possibility of withdrawal of operating license.
  • For statement wey NCC drop earlier, dem advise di general public to ensure say dia NINs dey captured inside dia SIM registration data.

    Di statement add say all inconveniences wey dis directive go cause dey deeply regretted.

    NIMC registration deadline: NIN link for MTN, Airtel, Glo, Etisalat sim cards
    Wetin we call dis foto,

    NIN Registration

    [NCC SIM registration] Background

    Nigerian Communications Commission [NCC] begin implement new measure for mobile phone SIM users since late 2020 wey include compulsory update of valid National Identification Number [NIN].

    Dis na in order to improve on di achievements of last year SIM registration audit and improve di performance and sanity of di telecommunication sector.

    Na sake of dis di Nigerian Communications Commission (NCC) and all stakeholders agree from now say e don become very important to improve di integrity and transparency of di SIM registration process inside di west African kontri.

    And when millions of subscribers dey blocked, di telecommunications company no go too make money from Di pipo like day and dis go affect dia contributions to do economy.

    .

    Was my post useful? Support me to keep creating useful content

    Disclaimer If this post is your copyrighted property, please message this user or email us your request at team@pejoweb.com with a link to this post




    8 likes
     

    Advertisement

    ";

    Advertisement